Warri Proverbs..🤣
“”””””””””””””””””””””””””””””””””
🔅1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.
🔅2. Book wey no gree enter head go enta exam hall .
🔅3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.
🔅4. Who naked no dey chuck hand for pocket…!
🔅5. Wetin concern dog with family planning?..
🔅6. Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
🔅7. This one good, this one good na im mad man take dey gather plenty load.
🔅8. Pikin wey go strong go strong…. No be say until dem name am Samson.
🔅9. Na over confidence make February no complete.
🔅10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
🔅11. Head wey no wan think go carry load..
🔅12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.
🔅13. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish.
🔅16. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.
🔅17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.
🔅18. Feel at home, feel at home naim dey make visitor spoil remote .
🔅19. Escort me, escort me naso slave trade take start.
🔅20. It’s a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
🔅21. Christianity is free, but you must buy Bible
🔅22. Person nor dey use shame chop winch o
🔅23. Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.
🔅24. You no need spoon and cutlery to chop slap.
🔅25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
🔅26. The patient dog, nah hungry go kill am.
🔅27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.
🔅28. No food for lazy man no be for pesin wey im mama get restaurant.
🔅29. Who dey owe landlord rent no dey fry stew wey curry dey.
🔅30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh